pull down to refresh

This one enter my head well well.
‎My parable be this: Bitcoin address na like house number for Lagos - long, hard to remember, if you miss one number, your money don go another house. But name na like person name for village - "Robin@Bitcoin" - everybody sabi am, nobody go forget am.
‎Na why naming system dey important. Satoshi give us money wey no need bank, but we still need name wey human being fit remember.
‎My question be this: If you fit put your own name on Bitcoin today, which name you go choose? Your real name, or your secret Stacker name?
‎Me, I go choose @Chikasunbeats - because na that name my sats sabi me!